BENUE KILLINGS: THE NUMBER OF PEOPLE KILLED BETWEEN JANUARY AND APRIL
Benue: Herdsmen don kill 226 pipo between January and April - Goment
For February dis year, Nigerian Army flag off Operation Cat Race (Ayem Akpatuma) for Benue State, to take stop all di killi-killi wey dey happen as herdsmen and communities dey clash for some middle belt states of di kontri.
Most pipo for Benue State, and Nigeria feel say as military start di operation and as President Buhari order say make more security go di area, say di killi-killi go stop.
But e be like say noting don change, as communities for di state still dey suffer attack and bury more pipo.
Di one wey dey pipo mouth now na di 24 April own wen suspected Fulani herdsmen kill two catholic priests and 17 worshippers for Ayar-Mbalom community for Gwer East Local Government Area.
According to wetin BBC News Pidgin don find, na at least 226 pipo don die inside kill kill for Benue State, between January and April dis 2018.
Figures wey we gada from di Benue State goment, show say na Guma and Logo towns na im get di highest number of pipo wey die.
January, 2018
| DATE | NUMBER OF PIPO WEY DIE | PLACE |
| Jan 6 | 16 | Logo |
| Jan 6 | 7 | Guma |
| Jan 18 | 6 | Guma/Logo/Okpukwu |
| Jan 25 | 2 | Guma |
February, 2018
| DATE | PIPO WEY DIE | PLACE |
| Feb 4 | 6 | Guma |
| Feb 5 | 2 | Guma |
| Feb 9 | 3 | Anyii, Logo |
| Feb 12 | 2 | Kasseyo, Guma |
March, 2018
| DATE | PIPO WEY DIE | PLACE |
| Mar 5 | 5 | Umenge, Guma |
| Mar 5 | 26 | Okpokwu |
| Mar 15 | 3 | Guma |
| Mar 26 | 5 | Agatu, Guma |
| Mar 22 | 2 | Guma |
April, 2018
| DATE | PIPO WEY DIE | PLACE |
| Apr 5 | 10 | Gwer west |
| Apr | 10 | Gwer west |
| Apr | 10 | Ukum/Logo |
| Apr 12 | 41 | Ukum/Logo |
| Apr 16 | 4 | Logo |
| Apr 17 | 2 | Logo |
| Apr 19 | 19 | Gwer East |
| Apr 21 | 22 | Guma |
| Apr 24 | 19 | Gwer East |
Dis information come from di office of di press secretary to Benue State Governor Terver Akase, and security.



Comments
Post a Comment